Welcome, Guest: Join ECHOng / Login / Trending / Recent / News
Stats: 47,025 members, 241,157 topics. Date:   Tuesday 23rd of April 2024 06:37 PM

Top Members (April)
BigBallsBiden : 562 LilyNLSOFT : 133 uzy47 : 98 noah22 : 52 KellyE : 52 TitanKenneth : 30 haykings : 21 EMMALEZ : 14 synw : 14 bmdworld : 7
Top members are most active forum members

GL Pidgin!! Ndigbo! Make Una No Allow Army To Inject Una Pikin – Chief Ezeife - Naija Info - ECHOnigeria

ECHOnigeria Forum / Naija Info / GL Pidgin!! Ndigbo! Make Una No Allow Army To Inject Una Pikin – Chief Ezeife (1 Post | 409 Views)

(1) (Go Down)

ADD COMMENT

GL Pidgin!! Ndigbo! Make Una No Allow Army To Inject Una Pikin – Chief Ezeife by bello5653(m) : 3:05 pm


Person wey bin be Anambra State governor, Dr. Chukwuemeka Ezeife, don reject wetin person wey bin be Kaduna State Governor, Alhaji Lawal Kaita talk, as him say, North never get anything more dan wetin other states dey get.

Him also tell Igbo people, make dem no allow Army to inject dia pikin, as e follow fir Python Dance wey dem wan use kill Igbo people.

As Chief Ezeife talk with INCENT KALU, him say, Hausa people go be greatest loosers if dem divide Nigeria today.

Person wey bin be governor for Kaduna State, Alhaji Lawal Kaita,interviews wey im do with Saturday Sun talk say, nobody dey marginalise Igbo people . Based on wetin him talk, him say, igbos dey cry for wholf, wen wolf no dey ,

Him come ask questions say, wetin be di thing wey dey show say, Buhari dey marginalise Igbos, wen dem dey do well for dia place. My brother my sister, una agree with wetin him talk ?

Chief Ezeife talk say,

“I accept say, Igbo people dey do well, but make him know say, Igbo people dey develop anywhere dem day, as e dey for adage wey talk say, where person dey, na where him go cover well well. As e dey, make him know say, Igbo people don develop north wey be interior village “

” As we dey make progress, we no dey hide wetin we dey do, and any person wry wan vopy, make him copy for progress “

” God no marginalise Igbo people , but na everyone get di government. President Muhammadu Buhari, for him appointment appoint people wey pass 40,and him no put any Igbo person “

” Wen Buhari enter office, people him remove Igbo people wey get offices for Nigeria government, as e happen for NIMASA, as dem remove person wey dem already appoint.” “

” As e dey today, wen di National security council dey meet, no Igbo dey follow dem, based on say, Buhari remove SouthEast people wey be Christians, carry Muslims put for all offices wey dey for Nigeria Army “

” Buhari use Im bad mind, remove Southeast people only for di list wey dem write people dem remove from office.And as e dey now, SouthEast people no get any person wey dey represent dem for Nigeria “

” Nigeria get six geo-political zones and six major political offices, wey be : president, vice president, senate president, speaker of House of Representatives, chief justice and secretary to the government. Di last one be secretary for government, but no Southeast person wey be cleaner for di offices “

Di body language wey president dey give, dey show say, him hate Igbo people well well with him last blood. Army don kill plenty Youths, young men wey dey carry sticks for Aba; dem kill people for dia church ; dem kill port Harcourt Youths wey dey celebrate say, Donald Trump win American election “

Di Army never do Python Dance for, Kaduna, Katsina, Kano, Northwest, but dem dey use Army dey occupy SouthEast land. Dem don kill plenty people , and dem use plenty people for humiliation and dehumanization. You no see di videos, where Army force people to drink mud water; force others say make dem swim for mud. No bhumiliation? “

” Who talk say marginalisation no dey? Wetin dem don do for Igbos wey concern infrastructure?How many Federal Roads dem fix for Igbos? If di state government fix am, dem nogo give dem bac, based on say, na Igbo people use di money “

” Make we dey honest and Stop to dey deceive ourselves. We no fit mention di kind marginalisation wey Igbo people dey. Time don come wen we go dey talk if Nigeria dey treat people bad “

Upon all dis matta, stupid people still dey shout one Nigeria for SouthEast and dem no support secession. Youths weyno want am again don dey protest for secession “

” I remember say, di first month Buhari enter office, I talk am say, him dey push Igbo people out from Nigeria, wey don make IPOB and MASSOB to dey fight against di evil “

Di matta be day, Nigeria government wey dey under Buhari dey marginalise Igbo people and wan use Army and dia Vaccines to kill plenty igbo children. Di question be say, who make dem doctors and nurses?

The post GL Pidgin!! Ndigbo! Make Una No Allow Army To Inject Una Pikin – Chief Ezeife appeared first on GL Trends.




source: http://ift.tt/2gi4m84
http://ift.tt/2ynN2oJ

Everton And Liverpool Interested In Signing Charlton Wonderkid Ezri Konsa  Ghana’s Becca Unites Nigeria’s Female Musicians For An Evening Of Sisterhood  After nights of sleeping in uncompleted buildings, Nigerian lady bags First Class 

(1)

ADD COMMENT

   

(Go Up)

ECHOnigeria - Copyright © 2022. All rights reserved. Follow ECHOng on Facebook and Twitter
Inbox Peculiar (Forum Super Mod) If you have any questions (+2348171606466)
Disclaimer: Every ECHOnigeria member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on ECHOnigeria